|
|
 |
|
 |
 |
| Current Message |
Return to posts |
| From: Hamsterwheel |
Di UK govment don agree deal wit Nigeria to make am easier to remove pipo wit no right to dey for di United
Kingdom. For di first time, di Nigerian govment go recognise UK letters - wey be identification document issued to individuals witout valid passport - so pipo no go need wait for emergency travel documents to dey issued bifor dem fit return dem to dia kontri. Di agreement bin happun during President Bola Ahmed Tinubu state visit to di UK. One Downing Street tok-tok pesin say di two leaders "bin commit to deepening dia long-term partnership on trade, infrastructure and sustainable growth". Dem also agree to work more closely togeda on defence and security in response to transnational crime and terrorism, di tok-tok pesin tok.
https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4gxem3pdyvo
|
| Current Thread | Author | Time | | Hamsterwheel | 15:35:51 | | Free Thinking Doggie | 19:09:37 | | JonH🍕 | 19:32:22 | | Free Thinking Doggie | 19:13:29 |
You must log in or register before you can post messages (you'll be returned to this page once logged in).
© 2000 sell on the internet (soti) ltd |
feedback www.the-millionaires-club.co.uk ... FTIR Investments of Geneva Place, Road Town, British Virgin Islands
|
|